Saturday, 3 October 2015

These Pidgin Proverbs Got Me Laughing Like Crazy!!

 
Found this on Facebook, someone placed it as a comment on basketmouth'a safe sex photo.. The one I posted earlier (see here). I can't help it you all must laugh like me too. Lol. Enjoy...
1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin. 2. Woman wey never see problem... Na imdey still hold breast run. 3. Woman wey dey find pikin no dey wearpant sleep. 4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later e go hear am. 5. Na for afternoon dem dey find black goat. 6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.


7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD. 8. Man wen say sun nor go bit him back hungry go bit him front. 9. Small pikin wey dem carry for back noknow say the journey far. 10. Person wey don faint before no be stranger to death. 11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see. 12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains. 13. Yansh no get teeth but e dey cut shit. 14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself 15. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND. 16. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck. 17. Na cricket tell him children say, Nomatter how ground strong, Them no go sleep outside. 18. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man. 19. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat. 20. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch. 21. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open. 22. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS,BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOWBOOK. 23. Dem no dey tell tortoise say race don start wen bush dey burn 24. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food. 25. My pikin dey withstand hunger na food nor dey 26. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, nor go live to jump another day . 27. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury. 28. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am. 29. If e do u say everybody dey craze" na you dey craze. 30. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am. 31. My thing and our thing no be the same oh. 32. Na happiness dey make prick stand. (33) Potopoto no dey sink frog (34) No matter how river big reach,e no go fit drown duck (35) Dem no dey tell blind man say market don close (36) Who bellyful go still hungry (37) Deadbody no dey know how much him coffin cost (38) Hungry no fit make lion chop grass (39) No be who first start race dey first end am (40) Rabbit no dey vex for who kill am...na the person why show the killer him hole him dey vex for.


Kai our people!

No comments:

Post a Comment

Comments are a form of interactions! We always learn from one another!!